I’m gobsmacked by the sheer number of calls and messages I’m receiving from people who have Jobs, who drive cars and also live in fairly decent parts of Lagos that they want Rice, Beans and Garri from the #VSFCovid19Intervention.

Shey Una wan dey whine me ni?

Anyway, that’s my answer to you in the attached screenshot.

If e red for you wey get Job, get Salary wey you dey collect, dey drive Toyota Camry, e don black for some Pipo wey never see Bathroom Slippers wear for one year, dem still dey carry ordinary leg dey trek under hot sun. Abeg free me o.

We know say poor people dey everywia for Naija and we go try touch everywia wey we fit reach but shey Una sha sabi say no single Organization fit solve the problem of Poverty for dis we Countri abi?

This week sha, our VSF COVID-19 Taskforce go show for Lagos and Ogun States come do Brekete donation of Food, Medical Supplies, Personal Protective Equipment and Hygiene Products so make una dey ready for us. Everywia go soooooooft, make una no worry.

How is my Pidgin English sef?
TAO.